Ogbonge lawyer and pesin wey dey defend rights of Naija people and support development mata, Barr. Eze Onyekpere don hail lawmakers for donating a part of their salary for the fighting of Coro Covid-19 inside obodo Naija. But he say e go better make dem look into 2020 Budget again, kom change the constituency projects make e be things wey go help bodi-mata sector to pursue Coro komot for their constituencies and obodo Naija in general.
Barr. Eze wey be the Oga for Centre for Social Justice talk say if you add the constituency projects money for federal and state level, e fit reach N150 billion. He wan make dem siddon with bodi-mata experts, list wetin every constituency need to fight Coro and use the money to provide dem.
How you see this talk by Oga Onyekpere?