Home Covid 19 #Covid_19: You fit Use Ankara Face Masks but Wash Am Everyday –...

#Covid_19: You fit Use Ankara Face Masks but Wash Am Everyday – Bodi-mata Minister

448
0
Dr Osagie Ehanire: Naija Bodi-mata Minister

The Oga Minister for Bodi-mata, Dr. Osagie Ehanire don yan say kontri people fit use home-made or ankara face mask for Coro prevention but dem must take care of am make e no give dem other diseases. He say make people wey dey use different home-made face masks dey wash am every day with hot water and even iron am sef before dem go use am. But those wey dey use oyinbo face masks must throway am everytime after use.

Oga Minister talk dis one today when he and other members of the Presido Committee on Coro Control follow tori people talk. He talk say no be only mask fit protect people, say make kontri people no forget washing of hands, giving of space, staying for house, and other Coro prevention ways.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.