Home Covid 19 #Covid_19: We No Go Allow Africa To Be Testing Ground for Any...

#Covid_19: We No Go Allow Africa To Be Testing Ground for Any Vaccine – Word Health Organisation

548
0
Dr. Tedros Ghebreyesus - Oga patapata for WHO

The Oga patapata of the join-bodi of bodi-mata for obodo world wey oyinbo call World Health Organisation (WHO), Dr. Tedros Adhanom Ghebreyesus don yan say dem no go allow Africa to be testing ground for Coro vaccine or any other vaccine for dat matter. He say that talk by 2 French scientists say dem wan test Coro vaccine for Africa na very bad talk wey turn im belle well well so tey he wan vomit. Oga Ghebeyesus say WHO go make sure that testing of any vaccine or drug go follow standard rules and procedures wey the world don dey use before.

He wonder with vexation why any pesin for dis 21st Century go talk about Africa like say na Colonial days we still dey. See as Oga Tedros take talk am ” “And the hangover from a colonial mentality has to stop, WHO will not allow this to happen.”

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.