Home Covid 19 #Covid_19: We Need More Protection Equipment for FMC Lokoja – Dr. Agwu,...

#Covid_19: We Need More Protection Equipment for FMC Lokoja – Dr. Agwu, Doctors’ Presido

671
0
Dr. Nnanna Agwu - Oga Presido for FMC Lokoja Resident Doctors

As Coro dey jump like monkey from one pesin to another inside we country, plenty bodi-mata people don dey yan government to make sure say enough protection equipment dey. We follow the Oga Presido of the association of doctors wey dey do higher training to become specialists (a.k.a Association of Resident Doctors – ARD) for Federal Medical Centre (FMC) Lokoja, Dr. Nnanna Agwu talk dis weekend and im tell us plenty things. We go dey komot am small small.

Dr. Agwu talk say im hospital no get protection equipment wey oyinbo call Personal Protective Equipment (PPE) wey doctors, nurses, and other bodi-mata workers go use dey protect themselves from Lassa Fever and Coro as dem dey work. These equipment include hand special hand gloves, face mask, eye googles, face shield, head cover, gowns, etc. He yan say e reach 9 people wey don kpai from Lassa fever dis year alone for Kogi State and dem bin get 74 suspected cases. He come remember Dr. Idowu Ahmad – a young doctor for dia hospital wey Lassa fever kill 2 years ago because of lack of protection equipment (PPE).

This ogbonge doctor wey e no go tey for him to become confam specialist on top anaesthesia mata (doctors wey dey make people sleep or no feel pain during operation), squeeze face on top the dying of one doctor for Katsina State and begged ogbonge and state government make dem no allow any other doctor or health worker die from Coro or Lassa Fever. He say Naija get 1 doctor for 6000 people instead of 1 for 600 people wey WHO recommend, and we go jump from frying pan enter fire if more of dem die.

Bodi-mata workers wearing protection against Lassa & Coro

Take dis one do Easter, we go bring you more tori from other things wey Dr. Agwu yan us.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.