The locking of everywhere to stop the spread of Coro don bring hunger everywhere, na so one Naija woman – Mrs Ezinne Ogbonna Aja cry out for a video wey she post inside her facebook page. She bin use her Igbo (Okposi) dialect do the talk o.
She talk say she dey live for Anambra State and a “painter” of garri wey dey sell N500 before don rise to N1,500. She kom lament say if no be the banning of waka into Ebonyi State, she for return to her farm for her Okposi village and harvest cassava to prepare garri. She beg foodsellers make dem use their church mind and bring down the price of garri and other types of food make hunger virus no kom kill people instead.
We join Mrs Aja dey beg government for every level make dem help kontri people especially di poor with food this period.