Home Covid 19 Covid-19: No Buy or Use Any Coro “Vaccine”, All Na Fake! –...

Covid-19: No Buy or Use Any Coro “Vaccine”, All Na Fake! – Ogbonge Govt yan Kontri People

553
0
Oga Lai - Minister of Informate

The Minister of Informate and Culture, Alhaji Lai Mohammed don tear warning give kontri people say govt don dey aware of yellow things wey people dey sell for Kano in di name of Covid-19 vaccine. He talk say scientists neva develop any Coro vaccine yet”. He talk say ogbonge govt go yan Naija people anytime wey any vaccine don get im carry-go.

Oga Lai come advice people wey dey sell fake vaccines for Kano make dem stop am with immediate alacrity. He do dis talk today when Oga Presido Coro Committee follow tori people talk inside Abuja.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.