Kontri pipo, e be like say dis Covid-19 don begin dey show im levels for Naija. NCDC confam 117 cases by 11.10pm, Tuesday 21st April 2020. Na Lagos, Abuja and Kano dey for front on top di new cases with 59, 29 and 14 Coro cases as e follow like dat.
As e be like dis, our kontri total don reach 782. 197 pipo wey get am before don recover go back dem house. Abeg, make everybody dey obey wetin NCDC or EHO talk about prevention.