Home Covid 19 By-force Miniminiwanawana and Home Beating don Rise by Half during #Covid_19 Lockdown...

By-force Miniminiwanawana and Home Beating don Rise by Half during #Covid_19 Lockdown – Lagos Govt

549
0
Mrs Titilola Vivour-Adeniyi

No be better tori dey komot from Lagos as di team wey dey torchlight and respond to di matter of by-force miniminiwanana and beating for inside house wey oyoinbo dey call domestic and sexual violence don raise alarm. According my di tori for inside Sahara Reporters, the Oga Coordinator of the Lagos State Domestic and Sexual Violence Response Team, Mrs Titilola Vivour-Adeniyi talk say dis badment don increase by half since di lockdown begin.

She talk say dem dey get like 8 reports everyday by day but e don rise to 13 every day. She tear warning give people wey do do dis bad thing say make dem komot hand of monkey inside soup before e go turn to human being own. She say Lagos State government go make sure anybody wey dey do violence especially by-force miniminiwanawanago hear nwii and receive maximum shishi according by law.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.