Home As e de hot #AsEdeyHot: Go, No “Sin” Again! Ebonyi Govt yans as dem Free Journalist...

#AsEdeyHot: Go, No “Sin” Again! Ebonyi Govt yans as dem Free Journalist wey dem Gbab for Writing Lassa Fever Tori

619
0
Chijioke Agwu - tori pesin for The Sun in Ebonyi State

The mind of Mr. Chijioke Agwu go dey totori now as he no go sleep inside police detention dis night. Tori wey just dey reach us talk say Governor David Umahi don order make dem release am as the baskets of abeg wey dey come from Naija Union of Tori People (NUJ), Guild of Editors and plenty others don pour ice water for im vexing mind. According to the announcement wey di Ebonyi Commissioner for Informate, Barr. Uchenna Orji komot, di state don change mind and dem no go carry am go court again.

But as e be, Ebonyi Government don tear serious warning give all journalists for the state make dem no dey write anything dem no dey sure of. See as he take write am below;

We bin report about di kolobi of Mr. Agwu by Ebonyi Police with the order of di state governor. See di tori wey bin vex di governor for here. Kontri people don dey write with vex on twi-twi and facebook on how governors dey arrest tori people anyhow say e don pass don’t be silly!

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.