Home As e de hot As E Dey Hot: Coro Don Kpai Prezido Chief of Staff, Abba...

As E Dey Hot: Coro Don Kpai Prezido Chief of Staff, Abba Kyari.

429
0

The Chief of Staff to Naija Prezido, Mallam Abba Kyari don Kpai, on Friday 17th April 2020. Pesin wey dey help Oga Presido on top Media mata, Mallam Garba Shehu post di sad tori for twi-twi.

Abba wey been show Naija from Obodo-Oyibo after him travel, dey among the first set of cases of Coro for inside Naija. After him test positive to Coro, tori carry am say he fly go Ladgidi for treatment.

Although, tori been commot say Abba Kyari dey respond wella to treatment and him body go soon dey kakaraka, but no be wetin later sup.

Him die of Coro and other body-mata complications.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.