Jerking up of mind don dey for Ebonyi State now as the Governor, Engr. David Umahi don talk say wearing of face mask na by force. According by the public announcement wey dem komot today and signed by the Commissioner for Informate Barr. Uchenna Orji, Gov. Umahi approve make dem arrest anybody wey komot im house from tomorrow 4th April without covering im face with face mask, hankerchief or even head tie. People wey fit do the arrest, according by wetin the governor approve na police, army, civil defense, plus including Chairmoo of LGAs, Coordinators and any govt official .
See the full announcement for this photo as the commissioner take write am;
How you see this order from Ebonyi State Government?