Covid-19 spreading don enter anoda gear as NCDC announce 51 new cases and 9 for inside Kwara State. According to di post for twi-twi wey ogbonge journalist wey sabi torchlight serious mata, Mr Fisayo Soyombo, dem don confam Coro inside di bodi of 3 resident doctors, one specialist doki, and one nurse wey dey work for University of Ilorin Teaching Hospital.
Na Oga Fisayo bin blow di tori say one Prof. Alakija Kazeem Salami for di hospital bring im friend wey carry Coro return from obodo oyinbo kom treat for di hospital with hiding of im travel history. Im friend don kpai and di hospital don nack suspension give di prof for wetin dem call “unethical conduct”.
We no know whether these doctors wey don test positive touch bodi with Prof. Salami friend. Two doctors don kpai on top Coro-related mata, one for Katsina and anoda one for Lagos.