The tori wey we reach us today no sweet belle at all o. The University of Abuja Teaching Hospital, Gwagwalada no go see or admit new patients from tomorrow, 31st March 2020. This one mean say out-patient clinic no go open. Na only emergency cases dem go dey see. Na the letter wey dem give all di ogas of departments carry this informate.
One senior doctor wey dey work for the hospital but no wan make we write im name talk say the decision na because di hospital no get enough protection equipment for dem workers and dem no wan carry Coro from the isolation centre give themselves or to other patients.
The hospital talk say the closure no go affect patients wey don dey for admission or the Coro patients wey dey their isolation centre.