Home Things wey happen “Heat Dey Pursue Patients Komot from Taraba Specialist Hospital” – Papa...

“Heat Dey Pursue Patients Komot from Taraba Specialist Hospital” – Papa of Pikin Wey Dey on Admission

697
0

Naija man, Mr. Chime Chinonso don raise alarm for inside facebook say heat dey pursue small pikins wey dey on admission for Taraba State Specialist Hospital, Jalingo komot from the hospital. He talk say im pikin dey on admission for 2 days, no fan inside the ward dey work. He talk say plenty parents bin carry their pikins komot because the place hot like where dem dey bake bread. He come wonder whether di barber no sabi barb abi di clipper no sharp.

When we follow am talk today, Mr. Chinonso talk say im pikin was discharged today as he don well. He complain say the condition of the hospital no pure and the doctors and nurses wey im follow talk no happy about the situation. He wan make government show seriousness to make the hospital dey good enough to treat and heal people.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.