Home Covid 19 Ebonyi Governor dey Jinja to Prevent Coro (Covid-19) but Some of im...

Ebonyi Governor dey Jinja to Prevent Coro (Covid-19) but Some of im Prevention Messages No Pure

476
0

The Governor of Ebonyi State, Engr. David Umahi don carry serious jinja dey waka about by himself to make sure say everybody dey do the right things to prevent Coro make e no enter his state. Tori wey reach us confirm say the governor bin visit banks and food joints to inside Abakaliki to make sure say dem dey do the right thing. Watch am for the video here. Plenty Ebonyi people wey post about the waka for Facebook bin hail the governor for im jinja.

But as e be eh, some message wey the governor talk on the prevention of coro no be true. Make we analyse his messages below:

  • Touching of hands for face, nose, mouth and eyes fit spread Coro – TRUE.
  • Nose (face) masks dey very importankpa, if you no get am use hankerchiefs – TRUE BUT NO BE FOR THIS CONTEXT. Na people wey get the virus or those wey dey around pesin wey carry Covid-19 like bodi-mata workers or caregivers suppose use am. E go reduce the chance but dem fit still catch am if dem no observe other prevention methods. E good make people cough into hankerchiefs and throway am immediately.
  • One pesin with Covid-19 na threat to everybody – TRUE
  • Sanitizing metal detectors for banks go help prevent Coro – TRUE
  • Covid-19 no dey survive under heat – NOT TRUE, evidence no dey to support this talk.
  • Air conditioner, ice cream and cold environment fit spread Coro – NOT TRUE, no evidence.
  • Hot water, lemon, garlic, ginger dey prevent Coro spread – NOT TRUE, evidence no dey to back am.
Gov. Umahi (middle) and im team during them Coro prevention waka

E go good make powerful people like Governors dey use only Coro prevention message wey NCDC don prepare.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.