Home Covid 19 #Covid_19 Lockdown: We No Get Food For You Again! – OAUTH Ile-Ife...

#Covid_19 Lockdown: We No Get Food For You Again! – OAUTH Ile-Ife yan Patients, Doctors

664
0

Coro lockdown don begin cause kasala for town o. Yesterday we bin report say UniAbuja Teaching Hospital say dem no fit see patients for clinic again. Same yesterday, the Obafemi Awolowo University Teaching Hospital wey dey for Ile-Ife, komot letter to Department Ogas, say dem no go fit dey give food again to patients wey dey on admission and doctors wey dey work overnight. Dem talk say the Coro lock-down for Osun State no go allow them find food for market. This order dey start today and na like dis e go be throughout the period. See the letter below:

As e be like this, na to your tents o Israel. But we just dey reason how patients wey dey for admission go take survive, as motor, keke or okada no dey move. How their family members wan dey pass to bring food for them? What about patients wey their home dey far? How doctors wey dey duty go carry hunger dey work? As e be, na hunger fit kill more people than Covid-19 sef. Abeg, OAUTH Management e no easy but make una look this matter again o.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.