Katsina State Government say them don record their first suspected case of coronavirus since the virus enter obodo Naija.
The permanent secretary of the state ministry of health, Dr. Kabir Mustapha naim talk this thing say; The patient been come back from Malaysia, come notice say body no dey kakaraka, naim make the patient wan know wetin dey sup with him body.
Mustapha say the patient dey self isolation now, and them don collect samples from him body wey them go test to know wassup, him come say the test result go come out on thursday 19th March 2020.
Stay with us, we go bring u the tori as e dey hot.