Na just yesterday wey the President of Nigeria, Muhammadu Buhari announce lockdown for Lagos and Abuja, as from 11pm, Monday 30th March 2020.
Today everybody from everywhere inside Abuja, commot go buy chop-chop and other things bokku to keep body and soul during the period of the lockdown. Traffic hit some major areas of Wuse, Garki, Apo, AYA to Nyanya axis of Abuja.
TalkHealth9ja go A.A Rano gas station for Nyanya, the population of people wey wan buy fuel and cooking gas choke, we come ask one of the attendants wetin dey sup, him say e no sure say them go open tomorrow and people choke because e fit no easy to get fuel and gas as from tomorrow.
We follow some people yan too, them say cost of transportation maranma today, and from AYA to Nyanya nearly reach 3 hours because the go-slow nor dey move at all.