Home Uncategorized #Coronavirus: No Follow Rumour Mongers, Na We Dey Yan the Koko –...

#Coronavirus: No Follow Rumour Mongers, Na We Dey Yan the Koko – Health Minister

601
1
Dr Osagie Ehanire: Naija Bodi-mata Minister

Dr. Osagie Ehanire wey be the Oga Minister of Bodi-mata don beg Naija people make dem dey follow wetin the Minstry of Health, Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) and Lagos State Ministry of Health dey tell dem about the prevention of Coronavirus (Covid-19). He also draw hand for ear warn rumour mongers make dem march break with immediate alacrity as dem dey pour sand sand for garri on top the fight against the virus. The Oga Minister sef tell country people to shun spreading of any kind rumour and make dem no listen to them at all at all.

The Minister advise Nigerians wey waka go obodo oyinbo and return in the last 14 days and im bodi come dey do am somehow, or anybody wey dey suspect say im get Coronavirus, make dem report sharperly to @FMoHNigeria 0909 299 6283, 0809 555 3232, @NCDCgov 0708 711 0839, WhatsApp 0809 955 5577, SMS Toll free: 0800 970 0000-0010

He also talk say more than 80% wey get Coronavirus Covid-19 no dey get serious sickness, na few fit get severe sickness of body or even die from am.

1 COMMENT

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.