Home As e de hot #Coronavirus: “I dey Kampe! I no dey for Quarantine” – Oga NCDC...

#Coronavirus: “I dey Kampe! I no dey for Quarantine” – Oga NCDC DG

435
0
Dr. Chikwe Ihekweazu - NCDC Oga

There was jerking up of mind among plenty Naija people yesterday when the Oga Minister for Bodi-mata, Dr Osagie Ehanire tell House of Reps say the Oga for Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) – Dr Chikwe Ihekweazu dey for “Self-Quarantine” for 14 days. When tori people report am for different newspapers, fear come catch everybody. People come dey think say the Covid-19 virus enter im body for China wey he follow ogbonge sabi people wey World Health Organisation (WHO) gather, go look as dem dey take manage the outbreak for there.

But Oga Chikwe himself come cry out through him twitter say, “I no dey sick ooooo, I no dey for quarantine oooo”. He talk say im dey work from inside his house to follow the rule wey talk say anybody wey go China no go mingle with people for 14 days to prevent any kind spreading of the virus. NCDC sef come bring out message for tori people say their Oga DG dey gidigba, say dem don test am and he no get any symptom wey fit suggest Covid-19. Them say wetin their oga na example say nobody dey above their rule.

When TalkHealth9ja follow Oga Chikwe wife – Mrs Vivianne Ihekweazu talk, she confirm say her husband dey kajad and dey work very hard from home to make sure say the virus no spread for inside obodo Naija. She thank country people for the love and support.

So e mean say Coronavirus don put Oga Chikwe for “house arrest?”. We dey wish am well.

Dr Ihekweazu with other sabi people wey WHO send go China

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.