The Ogbonge Minister for bodi-mata, Dr. Osagie Ehanire don announce, with squeezing of face, say five new pesin don get Covid-19 for obodo Naija. This one don make the total number of cases to eight (8). He announce am today through im twitter account.
He talk say NCDC go follow everybody wey touch bodi with people wey carry the virus to make sure say the spread no too increase.