Home As e de hot Coro (#Covid_19) don vex for Ibadan! UCH CMD, Provost UI College of...

Coro (#Covid_19) don vex for Ibadan! UCH CMD, Provost UI College of Medicine and Deputy don carry am!!

544
0
Prof. Jesse Otegbayo
CMD UCH Ibadan

Kontri people, make we no allow water pass garri for this Coro mata o. E don carry vex dey spread for Ibadan, Oyo State. As NCDC activate University College Hospital (UCH) Virology Lab make dem dey do the Coro testing, na so the Ogas for the hospital come do testing and three don dey confam say Coro dey inside their body.

The Chief Medical Director, Prof. Jesse Otegbayo komot public message for tori people about im status. We also read for another newspaper say the Provost of the University of Ibadan College of Medicine, Prof. O. Olapade-Olaopa and deputy, Prof. Obafunke Denloye wey their office dey opposite the Coro testing lab also carry am.

Prof. E.O Olapade-Olaopa
Provost, UI College of Medicine

The good part of the tori na say three of them no dey show any symptom but the virus don put them for house arrest for 14 days. Dem advise everybody wey dem don touch body with make them stay one place (self-isolate) and call NCDC if they show any symptom.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.