The Ogbonge Ministry for Bodi-mata (Federal Ministry of Health) don call meeting of sabi people to plan on how dem go take pursue cancer of the cervix komot for obodo Naija. According by the invitation letter for this meeting wey we see, the meeting go hold for inside Abuja tomorrow, Thursday 5th March 2020. These sabi people go help plan a bigger meeting wey dem call “National Stakeholders Forum on the Elimination of Cervical Cancer in Nigeria”.
People wey go attend the meeting include Ministry of Health people, specialists on top cancer matter, NGOs wey dey work to prevent cancer and plenty others.