Home As e de hot Naija Don Get 3 Laboratories Wey Fit Test For Coronavirus-NCDC.

Naija Don Get 3 Laboratories Wey Fit Test For Coronavirus-NCDC.

605
0
Photo Credit: ncdc.gov.ng

Naija don ginger well to fit fight Coronavirus anytime wey e show face for we country. As e be so, Naija don get three (3) laboratories wey fit test for Coronavirus.
These laboratories na; the Nigeria Centre for Diseases Control, NCDC, National Reference Lab, Abuja, for inside Federal Capital Territory, FCT; the Virology Laboratory wey dey Lagos University Teaching Hospital, inside Lagos, and Irrua Specialist Teaching Hospital, Edo State.

The Director-General of NCDC, Dr. Chikwe Ihekweawu, talk say them collabo with partners to set up these laboratories. Partners like Public Health England, Robert Koch Institute, WHO Nigeria, Africa CDC, and  Bernhard-Nocht-Institut fur Tropenmedizin.

E never tey wey minister of health, Dr. Osagie Enahire say, Federal government don tanda for airport with enough this-and-that and akanuche to fit discover Coronavirus immediately e try to enter Naija. With this amount of preparation we believe say las las we go dey alright.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.