The Lassa fever cases since the beginning of 2020 don increase to 365, and 47 people don kpai from this disease. The states wey dey affected sev don rise to 23 across 74 LGAs’. These states na; Edo, Ondo, Bauchi, Borno, Ebonyi, Nasarawa, Kano, Kogi, Kaduna, Adamawa, Cross River, Delta, Osun, Ogun, Abia, Taraba, Plateau, FCT, Gombe, Enugu, Kebbi and Anambra.
Five body-matta care workers sev don kpai from this disease, last week; three (3) from Kano state, one (1) from Taraba state and one (1) from Borno state.
This week sha, people wey Lassa fever kpai no plenty like for the last report, unlike the last report wey 19 people kpai, this week na only 6 new deaths them don record.
Shey we fit say the
matta don improve, based on this report or Naija still need to do more, because
no form of preventable yama-yama sickness suppose kill guy-man. But everything
start from us, make we take preventive measure so that everybody go dey
alright.