Lagos state don start to dey train 342 Naija-based body-matta workers as first-level emergency responders for communicable diseases for the 20 Local Government Areas and 37 Local Council Development Areas of the state.
Director-General, Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA, Dr. Femi Oke-Osanyintolu disclosed talk say, the training na part of the work wey ministry of health dey do to prepare for the spread and possibility of say communicable disease like Coronavirus, Lassa Fever and others fit enter Naija.
World Health Organization don say Lassa fever outbreak for inside Naija dey happen every year, during dry season, but this year own maramma pass other years own.
Meanwhile Chinese body-matta expert too don say Coronavirus na airborne virus, that is to say, the virus fit transmit through air wey guyman dey breath, this tori come increase the palava, no wonder wey e dey spread like that. So therefore, Naija need to do more, so that when the matta hit us, e no go pass body.