Home As e de hot #Coronavirus: Protect Yourselves but No Panic – FG to Naija People

#Coronavirus: Protect Yourselves but No Panic – FG to Naija People

810
2
Dr Osagie Ehanire: Naija Bodi-mata Minister

With the outbreak of coronavirus inside obodo Naija, the Federal Ministry of Health don yan Naija people make dem no fear or panic at all but do everything to protect themselves from contacting this disease. According by the statement wey the Oga Minister, Dr. Osagie Ehanire sign by himself, ogbonge government say dem dey work with the Lagos State Ministry of Health to make sure say water no go pass garri for this matter.

The ministry come list ways wey Naija people go take protect themselves from coronavirus (Covid-19). Dem no hard sef, washing of hand with soap and running water follow, covering of mouth with tissue when sneezing or into the elbow and staying away from people wey dey sneeze anyhow na some prevention methods.

See others inside this statement by Oga Minister.

2 COMMENTS

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.