Small pikin today, go old one day, and na everybody prayer to become old before them leave this world. But no be everybody dey prepare for all the wahala wey dey come with old age.
The sickness wey dey associated with old age dey begin show face from person late forties (40s), so when person don pass fifty years (50) of age, e dey good make the man or woman dey go hospital for regualar checkup.
Sickness wey old age fit cause plenty, some of them na:
- Stroke
- Hypertension
- Cancer
- Dementia
- Cataract
- Arthritis
- Packinson’s Disease
- Type 2 Diabetes
- Organ Failure etc.
We fit care for our body from when we dey young make we fit enjoy our old age wella, if we dey do these things;
- Go hospital for checkup when your body dey do you one-kind two-kind, no allow am pass 72 hours before you go hospital.
- Bath, make you wash your body wella and regularly.
- No dey take drugs without doctor prescription.
- Drink enough water daily.
- No take hard drugs because, apart from the fact say e fit make you kolo, e fit cause problem for you when you don dey old.
- Do at least 30 minutes exercise daily when you still young, you go enjoy am when you don old.
- Take care of your environment, make you keep am clean at all times.
- Body no dey too old for execise, when you old, even if na to stroll around for some minutes everyday.