Naija flag been fly high for inside Yankee Capital (Washington DC, USA) last week as Ogbonge Cancer Fighter and Founder of Project Pink Blue, Mr. Runcie C.W. Chidebe bin win the 2020 IVLP Alumni Award for Social Innovation & Change. Oga Runcie bin follow do the United States International Visitors Leadership Programme (IVLP) in 2016. The US government talk say the work wey him dey do by fighting cancer without matching of break dey sweet dem belle well well. They come give am opportunity to talk to everybody for the 2020 Global Ties U.S. National Meeting in Washington, DC on how dem to help make obodo world better place.
This award na one of the plenty awards wey this sabinus don win for im life. Inside University of Nigeria wey he go school, na him carry first for Psychology Department. He don win Tony ELumelu grant. Even for far away Malaysia, he bin win world award for organising biggest World Cancer Day event inside Naija.
We dey like better thing o. Congratulobia to Oga Runcie for making Naija proud once again.