Home As e de hot Lassa Fever Update: People Wey Get This Yama-yama Sickness Don Dey Bokku.

Lassa Fever Update: People Wey Get This Yama-yama Sickness Don Dey Bokku.

426
0
Photo Credit: Vanguard News

As e dey hot, the Lassa fever palava never slow down, to keep Naija up to date with the tracking and efforts to end Lassa fever, Nigeria Centre for Disease Control NCDC, don release another situation report wey cover the 4 weeks of the month of January.

  • For inside 2020, suspected cases don increase from 255 to 689, confirmed cases too don increase from 82 to 258, and people wey don kpai from this disease don increase from 14 to 41.
  • Out of thiry-six (36) states, nineteen (19) states get confirmed cases of Lassa fever from 56 LGAs’.
  • States wey get confirmed cases of Lassa fever, and the number of confirmed cases na; Ondo 96, Edo92, Ebonyi 15, Taraba 10, Plateau 7, Bauchi 7, Ogun 1, Abia 2, Kogi 4, Adamawa 1, Benue 1, Bornu 3, Delta 5, Enugu 2, Kaduna 1, Kano 3, Nasarawa 1, Osun 2, Rivers 3.

Wetin Naija Dey Do About Lassa Fever Palava.

  • The National Emergency Operations Centre (EOC) don dey activated to coordinate response activities across states.
  • NCDC don send rapid response teams to support activities for these states.
  • The five molecular laboratories for Lassa fever testing wey dey NCDC network dey work in full capacity, to make sure say sample testing and results dey happen sharp-sharp.
  • NCDC dey work with other states to get treatment centre, and support the ones wey don get with care, and things wey them need to treat Lassa fever patients.
  • NCDC sev don use social media, radio, television and other necessary means to use educate people about the risk, symptoms and other things wey them need to know about Lassa fever.

To check out the full tori for this report, click HERE.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.