Home Things wey happen Pink Oak, Pillr don join bodi to fight Cancer

Pink Oak, Pillr don join bodi to fight Cancer

616
0

The Pink Oak Cancer Trust – number one ogbonge NGO wey dey raise money dey sponsor treatment of cancer patients inside Naija don join bodi with Pillr to fight cancer. According by the post wey dem make for twitter and instagram, both organisations say dem don become partners to help sponsor more cancer patients.

Pillr na mobile application wey Muslims fit pay their Zakaat and Sadaqah according by the teachings of Prophet Muhammad (SWT). From these payments, dem go give Pink Oak money to use and help Muslims wey dey fight cancer.

When he follow us talk, the oga for Pink Oak, Dr. Laz Ude Eze talk say this joining of hands with Pillr sweet am well well. He said Pink Oak don help 19 persons wey dey fight cancer inside 2019 alone and wants to do more. He come call on other religious organisations especially Churches make dem #DonateToBeatCancer by bringing tithe also for the sponsorship of cancer patients.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.