Home As e de hot Update On UCH Ibadan. The Asthma Patient Dey Alright-Mr. Akinrinola.

Update On UCH Ibadan. The Asthma Patient Dey Alright-Mr. Akinrinola.

636
0
UCH Ibadan

As e dey hot, we no go fit give una one side of the story make we no dig up the other side. If you dey follow the story about the alarm wey one Doctor raise concerning him brother wey get asthma and dey receive treatment for UCH, this na latest update.

So that we for fit get to the bottom of the tori about the alarm wey our docky raise a few days ago, we try with our muscle to get the contact of Mr. A. Akinrinola, wey be Head of Department (Information Department ‘PRO’), for UCH Ibadan, Nigeria.

TalkHealth9ja Follow am chat from our official whatsaap, him relate with us wella, we ask am a few questions; we ask am to react to the alarm wey we get say no functional Nebulizer to treat asthmatic patient wey dey UCH A&E Department, We ask say how many Nebulizers dey UCH and how many of them dey working condition.

As of now, the only comment wey him don make be say; him don dey follow the patient yarn, say the patient deny any negligence for the part of the doctors and medical personnel, in fact our guy-man don chop two times today, say the guy dey alright.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.