Home As e de hot UNICEF Dey Raise Alarm Say Malnutrition Don Nack Nasarawa Wella.

UNICEF Dey Raise Alarm Say Malnutrition Don Nack Nasarawa Wella.

354
0
Photo Credit: unicef.org

Malnutrition don cause palava for Nasarawa state sote the matta sev don dey tire people for the state.
Some body-matta workers wey dey for Dalhatu Araf Specialists Hospital Lafia, and other body-matta centres no gree talk the number of pikins wey them admit or the ones wey don kpai ontop Severe Acute Malnutrition(SAM) matter, but the general complain be say Ready to Use Food no dey to treat these children.

The Executive Chairman of the State  Primary Health Care Development Agency, Mohammed Adis, talk say this malnutrition palava no be only for Nasarawa State, e dey everywhere for Naija..
United Nations Children Fund, UNICEF sev don show concern about the yawa wey Severe Acute Malnutrition don cause for Nasarawa state. Coordinator of UNICEF for the state, Alhaji Yakubu Mohammed naim raise the alarm, explain say the increasing level of malnutrition inside the state need sharp solution, say make the state government pay their counterpart funds as part of steps to kill SAM for Nasarawa.

Him say the state government supposed pay about seventy million naira (N70m) to fit get over two hundred million (N200m) from UNICEF to fight SAM for the state.

TalkHealth9ja Dey use this opportunity beg Nasarawa state government to do their part, and also to beg interested persons and organization to join the fight against SAM, because e concern everybody.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.