Home As e de hot “UCH Ibadan Treated Doctor Brother Wey Get Asthma Attack Well”- Staff

“UCH Ibadan Treated Doctor Brother Wey Get Asthma Attack Well”- Staff

528
0
UCH Ibadan

We don hear the latest on top our tori – Abeg Help, Make my Brother no Die of Asthma inside UCH Ibadan! Doctor Cries Out to Colleagues – wey we bin publish yesterday. One doctor wey dey work inside UCH Ibadan (e say make we no put im name) don yan say the tori wey we bin hear that no nebuliser dey work for inside UCH Ibadan no be true at all.

According by the doctor wey bin rush to the Accident & Emergency Department of UCH to see things korokoroically, UCH get 4 nebulisers (2 old, 2 new). The nebuliser dem bin dey use to treat the asthma patient bin develop small fault, but dem keep am carry another one treat am. Other people wey sabi about the matter talk say the doctor brother don get better treatment. Even the doctor don confirmate say im brother don dey alright.

We hear say UCH Ibadan management don dey torchlight the matter after the tori enter their ears. We don get the phone number of the UCH talk-talk pesin (PRO); we call am but he talk say e dey for meeting, say make we call am later. We go update una when we hear the official side. E go better for Naija!

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.