The wife of Naija Prezido, Mrs. Aisha Buhari, don advise Nigerians to embrace cancer advocacy to save lives. She talk say; she believe say, early detection and treatment of cancer disease dey necessary to save the lives of people wey get am.
Mrs. Buhari talk this thing on Thursday ontop her twitter handle ahead of the planned cancer awareness walk wey go happen on 26 October.
Na Medicaid Cancer Foundation inside Abuja dey organize this walk.
Mrs. Buhari beg Naija women and girls to dey do periodic examination of their breast to guard against breast cancer and other diseases. She come say make we join Medicaid Cancer Foundation to walk cancer commot for Nigeria.