Home Things wey happen We Go Strengthen The Collabo Between Oyibo and Traditional Medicines-LASG

We Go Strengthen The Collabo Between Oyibo and Traditional Medicines-LASG

425
0
Photo Credit: https://i.ytimg.com

Lagos state commissioner for body-matta Prof. Akin Abayomi, talk say strengthening the collabo between oyibo and traditional medicine and using wetin them get to improve Primary Health Care stand gidigba ontop Governor Sanwo-Olu government plan. Him talk am for the workshop wey Lagos state ministry of health join body with the Royal Dutch government to organize.

Him talk say, this collabo go reduce the wahala wey dey Doctors head for general hospitals, e go reduce the number of people sev wey dey go general hospitals for small body-matta complains, e go also improve Primary Health Care for the state.

Him con talk about the attitude of some of the people wey dey work for hospitals, say some of them no dey try at all, say him go dey visit them without telling anybody from time to time. People dey die because of wrong tests wey dey lead to wrong treatments, even the hospital environment sev no dey clean, toilets and the rest, him say all these things need to change.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.