You remember say when Ebola disease bin break out for Naija in 2014, no lab for we country fit do the torchightment? Na for Senegal we bin dey carry blood go for torchlighting and diagnosis. But levels don change o!
The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don nak hand for chest talk say Naija don take jinja enter next level on top the torchlightment and confirmento of Ebola disease for we country. Na the Director General of the centre, Dr. Chikwe Ihekweazu bin talk this one yesterday for Abuja during the meeting between the Committees on Health inside National Assembly and all the big big ogas for we bodi-mata sector. He talk say this test dey happen inside the National Reference Laboratory for Abuja.
Dr. Ihekweazu also shared plenty other achievements wey include the setting up of Public Health Emergency Operation Centres for States. He also listed the wahala wey NCDC get; dem include incomplete sabinus pesin to work for lab, incomplete money, dulling of state government on top “health security”, etc.
He thanked Presido Buhari, Oga Minister dem for bodi-mata and Naija people for all the support but like Oliver Twist, he asked for more.