Home As e de hot Vet Doctors Dey Raise Alarm Because of Yama-yama Diseases Wey Abattoirs Dey...

Vet Doctors Dey Raise Alarm Because of Yama-yama Diseases Wey Abattoirs Dey Generate.

520
0
Photo Credit: http://agronewsng.com

Meat sweet and everybody like am, make we no sha forget say plenty people na vegetarians too, but las las, most people no fit chop food if them no see meat ontop.

Abuja-Veterinary Doctors under the Nigeria Veterinary Medical Association NVMA, don raise alarm say diseases wey dey follow meat for abattoirs bokku, make Naija people dey careful. This reason be say abattoirs too dey dirty, and the people wey dey kill animals and those wey dey cut the meat sevĀ  no dey wash the caban well. Them even say most of the yama-yama diseases wey dey do our people and everybody wey dey this world na from dirty things wey people dey chop.

TalkHealth9ja dey use this opportunity beg government to make laws wey go make sure say people wey dey work for abattoir dey clean the place well, and to advice our people to dey watch where them dey buy food and meat, make sure say e clean well, and make them no forget to boil their meat well before them chop am.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.