Home As e de hot UNICEF- Over 34,000 Pikins Fit Die From Severe Acute Malnutrition (SAM) For...

UNICEF- Over 34,000 Pikins Fit Die From Severe Acute Malnutrition (SAM) For Taraba

481
0
Photo Credit: unicef.org

Mr. Bhanu Pathak, United Nation Children Fund (UNICEF) Nigeria Chief of Field Office, on Thursday, say over 34,000 pikins fit die from SAM for inside Taraba state, if them no do quick to do something about the matta.

Him say over seventy-five thousand pikins(75,000) under 5 years of age never collect immunization against polio and other yama-yama childhood diseases, him dey beg the state government make them handle the matta sharp sharp before yawa go gas.

Him talk all these things when him dey follow the governor of Taraba state yarn on Thursday.

Governor sev thank am well well, and thank UNICEF too for the work wey them dey do all around Naija, say e sweet am for belle well-well. Him talk say him government don try wella for body-matta sector but the greatest palava wey them get na insecurity. Him con assure them say Taraba state go work with Federal government to see say them handle this matta sharp-sharp.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.