Home Things wey happen Lagos State Don Close 52 Wuru-Wuru Chemist Shops.

Lagos State Don Close 52 Wuru-Wuru Chemist Shops.

465
0
Photo Credit: bbc.com

My people, make we no because of say we wan make money dey destroy other people lives. Apart from say we go die leave the money for this world, we need to remember say we go face judgement too.

E never too tey wey Lagos state task force close over 52 illegal pharmacies and drug stores for Isolo, Egbeda, Ikotun, Bariga and Somolu for inside Oshodi-Isolo, Alimosho and Somolu Local Government areas for Lagos, because them be wuru-wuru establishments, some even employ people wey no sabi anything about medicine to dey treat people.

As we dey go out everyday, make we shine our eyes wella, make them no go run us street, cause kasala for us, and make we put am for the front of the back of our minds say awoof dey run belle o.

If you dey do wayo and them never catch you, make u no think say na your akanuche dey work for you, e go better make you commot hand for the wuru-wuru business jeje, because everyday na for the thief but one day na for the owner.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.