A former patient of the Alex Ekwueme Federal University Teaching Hospital Abakaliki (AEFUTHA), Mr. Chukwudi Onu don squeeze face on the kind treatment dem give am for the hospital. According by the yan wey he give our tori pesin, Mr. Onu talk say dem collect im blood four times to do one test. “The people for the lab no dey organised at all. Dem collect my blood first time for test and told me the result go ready the next day. When I went to collect the result, dem kom talk say the blood sample don loss. This same thing happened the second and third time before I come rake them well well. Their oga begged me before dem collect my precious blood the 4th time. If na sickness wey go kill pesin, I for don die as dem dey loss my blood for inside lab”, na so he talk o.
E come advise all the ogas for the hospital make dem siddon, plan well and improve the quality of services to all patients dem. He talk say the hospital dey operate like open market wey people full everywhere and bodi-mata workers just dey behave anyhow.