Home Things wey happen Cross River government: Mama Abeg Give your tata only breast milk for...

Cross River government: Mama Abeg Give your tata only breast milk for the first 6 months.

469
0
Photo Credit: https://fabmumng.com

When papa and mama old, na the pikin wey them born go take care of them.

Nobody mama go open eye make her pikin dey suffer because of sickness, talkless of make the pikin die, even mama sev no go wan die when she never jolly untop her pikin mata.

For this year world’s breast feeding week wey happen for Cross River state, the Permanent Secretary of the Cross River State Primary Health Care Development Agency, Mark Uma Echeghe beg all the mama pikin-dem wey dey Naija, make them no give their tata anything apart from breast milk for the first 6 months after they just born, say e dey help clean yama-yama for the pikin body and prevent one thing wey oyibo dey call post-partum depression other yama-yama wey dey do mothers too.

Country people, when small tata dey happy, the mama go happy too, but nothing better pass when mama and tata dey happy together.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.