On 11th July for his ogbonge office in Alausa, the tear-rubber Governor of Lasgidi, HE Babajide Sanwo-Olu, bin make 3 promises on how dem go take finish malaria for the state. No 1 – he promise say the state government go increase releasing of money from budget for the implement of malaria program. No 2 – he go set up a committee wey go make carry serious jinja and swagger dey coordinate things for the fighting of malaria (a.k.a Lagos State Malaria Steering Committee). No 3 – he go sign agreement (MoU) with the malaria project wey obodo oyinbo UK dey sponsor for Naija (DFID SuNMaP II Project) and release their own part of the money for the project wey go happen for Lasgidi.
The Governor make all the promises in front of him deputy, Dr. Kadri Hamzat, Secretary to the State Government – Mrs Folashade Raji and plenty other officials of the state when the program people of obodo oyinbo UK department of international helping (DFID) hold meeting with am. The governor bin make other promise dem join but as dem no concern bodi-mata, we no go list them for here. Everybody wey follow go the meeting bin dey happy as plenty of them shine their 32 teeth when taking photo with the governor and his team. And na the SuNMaP2 people wey their belle don sweet well well send this better tori give us o.
[…] Abuja when she follow our tori people talk. She say belle dey sweet am like say tomorrow no dey as Lasgidi Governor Sanwo-Olu don promise to increase money for the fighting of malaria for their state… She come beg other governors and politicians make dem do like am and save plenty mama and pikin dem […]