Home Things wey happen Tufiakwa! South-South no get Cancer Treatment Machine – Runcie Chidebe

Tufiakwa! South-South no get Cancer Treatment Machine – Runcie Chidebe

967
0
Mr. Runcie Chidebe (front), Dr. Laz Eze (left), Koboko Master (right)

Chai…the matter of badment for care and treatment of people wey get cancer for obodo Naija especially South-South Zone dey turn the belle of Mr. Runcie Chidebe wey be the Oga for Project Pink Blue (ogbonge organisation wey dey fight cancer for obodo Naija). During the #CancerWalkPH wey be awareness and free testing for cancer , Mr. Chidebe and other people wey dey im side squeeze face, say tufiakwa join, because no cancer treatment (radiotherapy) machine dey work for the whole of South-South Zone.

E talk say as e be now, cancer patients wey need this kind treatment dey enter far journey go Abuja or Lagos. This kind waka dey stress them and increase the money wey they need for their treatment. He come tell State Governors and ogbonge government (FG) make dem komot this shame and help save people with cancer by making sure this machine dey for inside teaching hospitals in every state.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.