July 18, 2019 make am 5 years since your ogbonge TalkHealth9ja radio show start on top 99.5 Wazobia FM Abuja. On this day, we don enter next level by starting another ogbonge event wey we call Talk Health Evening (T.H.E). This event go dey bring together bodi-mata people, media people plus including informal sector people to talk as everybody go join hands improve health quality for obodo Naija.
The 1st edition bin take place yesterday inside Abuja. Chief Moji Makanjuola, MFR bin talk on how media go take improve bodi-mata quality for we country. Hon. Mohammed Usman bin chair the event. And more than 50 Naija people bin show face.


