When e come to the fight for better health and every other thing wey go help make body of people dey kajadly gidigba for Naija, one name wey you go always see na that of Dr. Nihinlola Mabogunje. This sabinus for bodi-mata wey plenty people dey call Mama Malaria don promise say dem go help the government fight Malaria finish for inside Lasgidi and the whole of Nigeria. Dr. Mabogunje na the Oga Madam for the Support to the National Malaria Programme (SuNMaP2) Project. But for their help to make better sense, the local, state and federal government go allocate better money and mobilise business people to join their own. The money will be used to pursue malaria komot for obodo Naija.
She talk this correct yan for Abuja when she follow our tori people talk. She say belle dey sweet am like say tomorrow no dey as Lasgidi Governor Sanwo-Olu don promise to increase money for the fighting of malaria for their state. She come beg other governors and politicians make dem do like am and save plenty mama and pikin dem from spending plenty money on malaria treatment or even dying sef. She also wan make Naija people join mouth to beg their leaders to take fighting of malaria more serious for we country.