Home As e de hot I go continue to support fight against Cancer – Hon. Usman

I go continue to support fight against Cancer – Hon. Usman

Former House of Rep Member, Hon. Mohammed Usman don promise to donate 50k to support treatment of cancer patients for Naija

713
0
Hon. Mohammed Usman

The before before member of the House of Represent , Hon. Mohammed Usman don vow to continue to support every better program wey go help improve the situation of bodi-mata for we country. Hon. Usman wey bin represent people of Makarfi/Kudan Constitutency of Kaduna State (June 2015 to June 2019) talk this one when he visited the Executive Director of Pink Oak Cancer Trust, Dr. Laz Ude Eze for his Abuja office.

He talk say although him na educationist, im experience as the Vice Chairmoo of the House of Reps Committee on Health Care Services show am say health sector needs plenty more support. He announced donation of N50,000 to support the better work wey Pink Oak dey do by helping the treatment of people wey get cancer. He also announce say im dey work with other Naija people to start a movement against one liver disease wey oyibo call Non-Alcoholic Steatohepatitis (NASH).

The donation of money against cancer totori the body of Dr. Eze as he carry 5 gbosas give the former Rep. He thank am plenty for all the better things he don do for bodi-mata sector for we country especially his support for more government money to take bodi-mata to the next level. He come tell all better Naija people to join am and #DonateToBeatCancer.

Hon. Mohammed Usman and Pink Oak oga, Dr. Laz Ude Eze

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.