Home As e de hot Asedeyhot! #ChurchToo: Serious Show of Vexation at COZA Church Now on top...

Asedeyhot! #ChurchToo: Serious Show of Vexation at COZA Church Now on top by-force-miniminiwanawana accuse wey dey for dem pastor head

1000
0

Country people no be small thing dey happen for the church premises of Commonwealth of Zion Assembly (COZA) church premises for Guzape Abuja now o. Show of vexation dey everywhere. Country people wey dey do we-no-go-gree waka on top the accusation of by-force entering of Busola Dakolo london by Pastor Biodun Fatoyinbo full there dey demand make the pastor step down. Police people sef full there to prevent any fight or destroying of things.

You fit remember say since last Friday wey this tori of by-force-miniminiwanawana break, plenty country people don dey show serious vexation on top social media against Pastor Bioun. Even after the pastor deny say he no do am, plenty people no believe his side of the tori as plenty women don accuse am of same matter before. Dem dey use different hastags #ChurchToo #ChurchMeToo #PastorStepDown #IStandWithBusolaDakolo dey post their vex-messages for social media.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.