Naija internet and social media don tear since last Friday, 28th June 2019 wey Busola Dakolo (wife of ogbonge musician – Timi Dakolo) carry accuse of by-force-miniminiwanana (rape) put on top Pastor of Commonwealth of Zion Assembly (COZA), Biodun Fatoyinbo head. Na inside video interview wey Mrs Dakolo do with Chude Jideonwo of Y! Naija TV she do the accusation o. She talk say e happen before she marry sef.
Since then, plenty country people and celebrities rush enter social media dey paravex on top the matter. Dem throw support give Mrs Dakolo for her courage to talk thismatter for public. This no be the first time wey this kind accuse dey Pastor Fatoyinbo head o. For August 2013, Ese Walters wey be former member of COZA Church bin don carry same accuse put on top this pastor head o. See the tori for here. The pastor bin no talk for 2013 whether or whethant he do am. But this time, he don komot one church paper talk say na BIG LIE Busola talk o. He even threaten say him go carry her go court. Some people sef join mouth to defend this pastor. Dem talk say na Satan dey use some people fight the body of Christ.
Things dey happen o. How you see this matter sef? Abeg, talk your own mind.
[…] fit remember say since last Friday wey this tori of by-force-miniminiwanawana break, plenty country people don dey show serious vexation on top social media against Pastor […]