The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) don talk say na Zamfara State get five (5) disease outbreaks wey be the highest in 2018 wey dem send body-mata sabinus to help quench am. States wey dey follow am with four outbreaks na Adamawa, Bauchi, Edo and Katsina State.
According to the NCDC Oga, Dr. Chikwe Ihekweazu, their agency bin send 51 sharp sharp response teams (Rapid Response Team – RRT) to 21 states wey bin get different kind disease outbreaks in 2018. He talk am during the launch of their 2018 Annual Report in Abuja. Dr. Chikwe carry plenty gbosaa give the Health Ministers wey go soon komot, Prof. I.F. Adewole and Dr. Osagie Ehanire. The report carry plenty informate on wetin dem achieve for 2018. He talk say dem dey shine their eyes well well respond sharperly by sending plenty body-mata sabinus wey dem don train to arrest diseases wey no wan behave.